Di immediate past govnor of Rivers State, Nyesom Wike, don confam say suspended Rivers State Govnor Siminalayi Fubara bin visit am wit two govnors.
For media chat wey happun for Abuja, di Federal Capital Territory Minister tok say Fubara bin come visit am wit two All Progressives Congress govnors and one elder.
Tori pipo Channels TV wey attend di media chat quote am say: “Unfortunately, di two govnors na APC govnors. So, I no go pursue dem. Im say im want peace. No problem. I also want peace.”
Im also tok wetin im tell Fubara for di meeting.
“I tell am say, Look, I no tink say you really get di capacity to make peace.”
Im explain say if Fubara really want peace make im call im supporters to order and make im also take steps.
“You don meet di Assembly pipo? E get leaders you suppose meet. No be to tok say I want peace, you must show am by conduct and action.
Wike add say na some govnors deceive Fubara wey make am land inside dis kasala.
“Govnors bin dey push am, wia dem dey now? I tink di govnors dey enjoy dia own.”
Kemmy
9 hrs agoDi immediate past govnor of Rivers State, Nyesom Wike, don confam say suspended Rivers State Govnor Siminalayi Fubara bin visit am wit two govnors.